Thursday, September 6, 2007

wetin?

Omo,this job don tire person.

what?!you no even thank God...some of your mates never get job

I mean i don old pass all this "patient was apparently well" business

so wetin u wan do now?

look,i go like make real wad...enough of this paycheck stuff

ehn ehn,i understand your problem

which problem?

you are an ingrate

how?

God for don leave u for lasgidi dey jump from one PP to another

At least person go don make contacts for government

Oh,so thats wat this is about?your aunty bunmi never escape im own mess.

look,can't u see the hand of esau and voice of jacob in this nonsense?

who's jacob and who's esau?

i dont know why you people wont leave bunmi etteh alone..na only she dey chop?

ehn ehn,but you yoruba people own dey too much,haba!

haven't you wondered why aso rock has maintained a deafening silencein this quagmire?

i know now...umaru dey fear..small time una go talk say na because she be yoruba!

thats why we no go gree progress...since doctor like u still dey see issues thru ethnic prisms.

so u wan dey defend am?

u know my stand on all existing politial structures in naija.

nothing dey impress u..i no know who worse pass from u and Gani?

take your time o!...at least i fine pass am!!..remeber say ngozi been get tight world bank job..before dem tempt amwith finance portfolio...now she's gone back to her first love.

but not without some indelible stains on her legacy

i've told u guys many times..expect no saints in thisbusiness.there's no smoke without fire...she sef for don chop blind!no be this country we dey with late solarin,wole soyinka,olu agunloye,olu falae,bolaji aluko....na only Gani never accept poisoned chalice.

wo, i no get power for naija politics again abeg....see your eaglets dey tap soccer...

where?

see..you don turn oyinbo finish!

ah...all those yeye age group football no gum me o...nobody dey watch dem for here.

wat about US open?

maybe the girls section....where there's actually some contest.serena lose to henin..again...the chic don finally finish!

i trust my guy federer

any of you folks who still enjoy seeing federer pummel the opposition had better go watch michael vicks dogfights...because federer is even worse than tiger woods...at least phil still kill tiger last week.

but nadal dey beat roger for clay now

...pssshhhh...abeg,i just dey wait make Novak Djokovic begin show those 2 pepper...the serbian is the awaited messiah in tennis!..and thismay be his grand slam.

go siddon.

ok i dey zap...as you no gree buy beer for boys!

omc

No comments: